Entertainment of Tuesday, 11 November 2025

Source: www.mynigeria.com

'I become comedian as Yahoo no pay me ' – Destalker

Destalker Destalker

Popular Nigerian comedian don open up on wetin e first dey do wey no pay am before e decide to enter comedy business.

The comedian for one recent episode of the In-House Gist Podcast, tok say e get one of e padi wey be introduce am to internet fraud, wetin most people dey call "Yahoo Yahoo" but as time waka, that e padi later turn pastor.

Destalker tok say the reason why e no succeed for the Yahoo business na because of the kind heart wey e get, say, e no see himself to dey scam people.

See wetin the comedian tok:

"Before I commot for Enugu, I try internet fraud with one of my padi wey don turn pastor now but I be no succeed for the thing. That time, we go book night session for cyber cafe for N200. I no get money to pay that time, so my padi dey always pay for me. He don turn big pastor now, Rev. Nelson Umeh.

"But, when my padi dey bomb clients online, I go just busy dey chat with my family, friends, and old schoolmates from Ughelli for Facebook. After I don chat them, I go fall asleep. No need to dey overspeed when you dey the wrong lane...

"But today, the story don change, because Yahoo Yahoo no be my destiny. I no fit defraud anybody because I get kind heart. Because of everything wey I go thru, I don grow confidence say nobody fit stop me from achieving my goal."