Entertainer Charly Boy has said the reopening of Senator Natasha Akpoti-Uduaghan's office by the Senate was as a result of fear of a crowd of protesters.
MyNigeria reported that Natasha's office was reopened on Monday after six months of the lawmaker facing suspension.
According to Charly Boy, the office won't have been reopened for Natasha to gain access if not for the protesters that turned up at the Senate premises.
He wrote on X, "If you AKPABIO me, I go NATASHA you.
"Yesterday, as thousands dey march go Senate, na im video begin fly up and down say Natasha office don open. Fear don enter.
"When Abdul Ningi was suspended 2024, dem no do video to say dem don open im office. When Ndume collect suspension, nobody do press conference to sweet Nigerians. But once crowd begin waka near gate, everybody turn PR officer. Na fear catch many yeye riffraffs for N.Assembly.
"No be say dem suddenly love Natasha. Abeg, make we no deceive ourselves. Dem wan use style save face, stop protest before e go pepper.
Who know when/how our own Nepal go happen.
"Na the set up dem dey arrange. When Senate resume, dem go carry motion say Natasha must apologize before we move on. But my people, apologize ke? The small tin i know about Natasha, she no go ever apologize and she no suppose, for what? Say one yeye man dey pursue am like he goat, even say she marry?
"Truth be told, na why Nigerians dey love her, she get strong back, she no dey bow. But make we talk true most of those He Goats wey full National Assembly or Sodum and Gomora dey shout up and down for Senate dey guilty of bigger wahala. Some dey carry women matter for pocket wey fit disgrace dem if e leak. Na why dem no get moral standing to dey shout Natasha name like say na she alone offend.
"I know we are headed for a Revolution, but nobody know how e fit take happen.
"Me, I dey laugh because this na typical Naija script, distract the people, spin small video, push small story. But Nigerians don dey wiseup. We don dey sabi say power dey our hand. If we fit shake dem small with march, imagine wetin go happen if everybody stand gidigba.
"For me, e clear: Natasha case na example say dem fit try, but no be every woman go bend. No be every woman na bush meat or Ntanta.
National Assembly Men pls respect ur prick."
ASA